.

in #fiction6 years ago

ogamat.jpg
EPISODE TWO – YEYE ORANGE
My broda, Slay Queen dem plenty for dis our obodo Naija no be small. E be like say some sisi dem, especially di ones for Lagos, just dey lay ambush dey wait any bobo wey don make coins, or wey tings don better for am small.
See me-o, just becos I talk small secret yesterday for dis my small page say Oga Sunny Okim don promise to change my guonguoro for me, come see as Lagos sisi dem come full our taxi park for near under bridge for Ikeja.
I go drop one passenger like dat for Ikoyi dat yesterday morning. As I dey come back, I pick like two different drop for road. God do well say di last passenger say na Ikeja Council Office e dey go. Una kukuma sabi say di office near our garage well well. I drop dat passenger for Council around 10 o’clock a.m in di morning, begin dey go garage to rest small. Before I drive cross under bridge enter our park, Idowu, our Union Treasurer meet me for road. E say make I no enter garage, say sisi dem full every wia dey wait for me. I tell Idowu make e comot for road make I pass. I tink say na one of dose im yeye jokes, after all, no be April fool we dey. My broda, as I just enter garage match break fiaam, na so four sisi like dat just rush me. One of dem wear one kind wicked mini like dat. E remain make di second one no wia anyting for top at all at all.
E just allow im paw paw to dey dance konkoma for im chest. And di ting stand paparapa. If you look di pawpaw, e go be like say e wan enter your eye. My broda, make I no lie, when I look di ting, I swallow one kind big saliva like dat.
My temperature just rise fiaam. But sha, I take style control my body. Di order two sisi no just carry. Front view na zero, side view nko? Dat one na yawa. Di boys quarter sef no just enter chart.
All of them come talk say so na me be Oga MAT? Dem say anytime wey dem look my photo for internet, dia body go just dey sweet dem like say na Segun Arinze dem see. Dem say me and Segun fine no be small. But dat na Baba Iyabo fine pass di two both of us. I say tank you. Di next ting dem tell me na congrats. I say for what. Dem say for my new car. Na dat time I come know dia mission. Dem be Slay Queen dem.
I come tell dem say make dem coolu temper, say wen di car land, we go wash am. Na so I take style discharge dem-o. But one of dem come gum imself for my body like aradite. E no gree go. Di sisi ready to work with me troughout dat yesterday. And e come be say na one of di yawa ones. I come talk am for my mind say wetin I wan take dis yeye orange do? Na so I tell am make e wait for me, say I wan rush go buy fuel for Conoil Petrol station for Ikeja Round About. I buy malt for am take pin am down.
Since dat day, I no near garage again. I hear say na so so sisi dem dey full for dia, to congra… cong … cong… (Abeg make I no bite my tongue).
Make we jam again tomorrow.
Tank you
Tank you very much
And tank you very very much indeed.

Sort:  

I will follow you and hope you will follow me as well, so that we can support each other and vote

Hi! I am a robot. I just upvoted you! I found similar content that readers might be interested in:
http://www.zjie.net/?p=345

Congratulations @ikannaokim! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Upvote this notification to help all Steemit users. Learn why here!

Congratulations @ikannaokim! You have completed some achievement on Steemit and have been rewarded with new badge(s) :

Award for the number of upvotes

Click on any badge to view your own Board of Honor on SteemitBoard.
For more information about SteemitBoard, click here

If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

Upvote this notification to help all Steemit users. Learn why here!