PRESIDENT FOR A DAY - A DREAM I LONG TO COME TRUE FOR MY PEOPLE

in Speak Peace4 years ago (edited)

Good day my fellow country people for we naija. My name na Faith and I be confam Niger delta pikin wey dey base for Pitakwa. If you no know, na Port Harcourt be that.

As I dey grow up, I don see many many things we make tears comot for my eyes, I don see poverty beat my neighbours children when their uncle na commissioner, I don also see market women wey dey sell day to day and at the end one task force man on duty go come collect their cut. For this same we country, I don see police wen harass driver before for 50naira and when fellow country men dey wicked to one another. This na many many things wey my eye e don see.

But today I wish say I fit change am for my country as the question wey dey on ground na say wetin I go do if me Sidan for that president chair.

img_0.9832170364154788.jpg
Image from Pexels

Based on all the things wey I talk say I don see, e move me to say I wan change some kind things make the masses no dey criticize everybody wey dey in leadership. Make them for take love me too the way them love Y'ardua

Firstly I go make sure say I strengthen the educational system for my one day tenure. Our educational system for We Naija e no balance at all at all. Yes we get some good schools but as student wey I be I don notice say enough funding no dey for some schools at all. Our laboratories dey lack plenty instruments and some school teachers no get enough textbook and supplies to use teach and sometimes when them get, na books of over 20years them dey use. I no dey see revised standard ontop. How we come expect our children to dey up to date?
Basic Education don dey free for some public schools but for my tenure I go make am better. I go make more supplies for books and other infrastructure so that children go fit dey learn well. I go increase the teachers salary so that them go fit dey photocopy small textbooks for children with shikini money.

Secondly if I be president, I go make sure say everyone for this country dey treated equally and fair. Nowadays our judiciary no dey independent. The court dey do any how them like. Bill go pass for everybody to dey under the law even me the president. If any case come for court, whether you hold high position for government you go face the law wey commoners they face too and any body wey for violate human rights go also get jail term whether na small pikin, old woman, old man or youth him tamper with. You no go escape justice and how I dey sure of justice? I go appoint committee wey go dey check corruption and wey go also work together to help impeach people wey their eye too dey chook for Nigeria money.

Furthermore, I go make sure say my own people for Niger delta no go dey skeptical about transparency again. I go give them hope. One of the things wey dey make them cause wahala na for say we no dey benefit from the oil wey our land dey produce.
I go allocate certain number of marginal oilfields to each south south state give the people of Niger delta for compensation.
img_0.13735020013390603.jpg
Image from pixabay

Lastly, before my one day tenure go end, I go allocate budget wey go feed the needs of the masses. Palliatives go dey reach poor homes every month and another committee go dey set up to search for employment for youths because I know plenty people wey dey Sidan ontop two people position for shell and other oil companies. We go create that employment for our young and able graduates.
img_0.37704262499958396.jpg
Image from pixabay

This na many things wey I go do as president. I no say e no easy but the change wey we go make na for You and I and for aam to work, na still all of us go put hand together. Una thank you for this opportunity wey una give me to express myself. God bless una my fellow country people.

Sort:  

Congratulations @faith65! You have completed the following achievement on the Hive blockchain and have been rewarded with new badge(s) :

You got more than 10 replies. Your next target is to reach 50 replies.

You can view your badges on your board And compare to others on the Ranking
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word STOP

To support your work, I also upvoted your post!

Do not miss the last post from @hivebuzz:

Feedback from the last Hive Power Up Day