CHRISTAIN

in #naijapidgin6 years ago (edited)

1102014603_univ_lsr_md.jpg

The Road, the Truth, and the Life
E dey sweet you to hear good news? The truth be sey good news dey for you, your family and your friends.
This good news dey inside Bible. Na Jehovah, the God wey make everything for heaven and earth use people write the Bible many years ago. For this book, we go put eye for four Bible book wey get good news for all of us. The four book dey bear the name of the people wey God use write dem—Matthew, Mark, Luke, and John.

39261297-stock-vector-holy-bible-design-over-white-background-vector-illustration-.jpg

Many people know this four Bible book as the four Gospels. Wetin all of dem write na the good news about Jesus. Dem write sey God go use Jesus save us. And since na im be the King of God Kingdom, if we get faith for am, e go bless us forever.—Mark 10:17, 30; 13:13.

I thank una for reading ,commenting,upvoting and resteeming...make una have a nice day