16YEAR OLD GIRL DON KIDNAP HERSELF DEMAND 600K FROM HER PAPA.

in #naijapidgin6 years ago

IMG-20180726-WA0003.jpg
Source

The Lagos State police command on Monday parade some suspects including one 19year old girl wey Dem dey call Dorcas Adilewa. Dorcas Adilewa fake her own kidnapping because want collect money from her papa.

The commissioner of police for Lagos State wey Dem dey call Imohimi Edgal talk say the girl plan am with her friend wey be Ifeoluwa Ogunbanjo and na the friend phone dem take call her papa tell am say make he send 600,000 naira bacause Dem don kidnap her and if he want see her again make he do am sharp sharp because delay oyibo talk say e dangerous.

Na so this girl papa want faint o. He come run gburugburu dey find how he want take rescue him daughter come land for police station, report the matter give them the phone number. Na so police begin dey investigate the matter come find out say the number wey dey use call am say na for ijebu igbo the person dey. Immediately Dem com send their anti-kidnapping squad go ijebu igbo go find the girl. When the girl see say water don dey pass garri and the blues don change to reggae na im she quickly call im papa tell am say Dem don release am.

That one no still stop police from arresting her make Dem understand wetin really happen. Na there and then Dorcas come confess say na she and her mama plan am o. She talk say her mama collect loan from cooperative and as time to pay reach, she no come fit pay am na im she say make Dem try their luck weda this plan go work but dey forget say when God call meeting for angels even devil show face.

As them dey yarn dey go Ogunbajo Ifeoluwa come shout say make them release her o say her hand clean for the matter. She say the levels no concern her because na for white garment church for ketu she see Dorcas who tell am say she escape from kidnappers motto run come ijebu igbo. As her friend wey she be she come carry am go her mama house give am food. Na even her mama give her 500 wey she take buy recharge card use the phone call her papa.

My country people how una reason this matter? Children of nowadays person no understand again o.

Na @zizymena carry this one come una domot today. today na Thursday. Anything you dey do, put God first o. Drive jeje, shayo responsibly because this life e no get duplicate.


If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought no to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing|@akintunde

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

Hmmm many things dey happen for this country oooo.

No be small o.

She don put price tag for her own head be that. Chicken wey dey excrete for inside pot, e no know say na im burial ground e dey spoil. Yeye child.

Lol
This ur proverb strong o.

😂😂

as i hear this one gbam! he suprise me oooo where is this world going to sef...... nawa ooooo
@naijapidgin una thank you for this awesome post.... God go dey bless u ooo

Bless u too my broda.

If no be say the papa self dey stingy, why mama and piking go just planning self kidnapping for him. Nawa for them o

O boy, @zizymena, you na guru for pidgin oooooo... I salute you. @naijapidgin I dey feel una. Una do well gan... My country people Wetin we no go see for this country. God pass the mother, daughter and mama person pikin Wey helep them.

@stevenmosoes

I don upvote and comment. Resteemed too. Una do well.

Na u try pass o..

Shayo responsibly that made me laugh a lot.

That a girl of that age could do that, there is something wrong with this world we are living in.

I dey tell u endtime don near

Wetin man eyes no go see for naija our country, she self wan turn slay mama ni. She wan use iphone x and gucci bag, na only baba God go help us for diz country. Children of now dem don join bad gang.

Lol
She don join bad gang.

dis matter pure pass pure water ooo.... d way wey dis matter dey go, somtin dey tell me say dat man na stingy man, na y dem get mind plan dis kind coup... but u know say any idea wey devil give dey always come wit gbege...

well sha i trust naija police, dem must collect money for fuel wey dem take go ijebu igbo...... but wait oooo @naijapidgin where d gial mama?

Make i laugh first. Hahaha
So mama and pikin plan to dupe papa.
Na only God go help us for this niga ooo

Things full we country o.

na de girl sabi,person wey be say her parent never beleful con dey form her own kidnapping. Notin we know go see for these our obodo nija

The mata weak person

@naijapidgin, oh boi dis mata eh no bi here ooo,but d mata eh, d girl no smart reach na

Posted using Partiko Android

Im sure that the father must be unapproachable, for a girl and her mother to plan such a terrible thing. However its a good thibg dey came out clean

This one weak me o. I know no wetin I go talk

Chai, imagine these children of nowadays...this is bad,why do they treat father's like this ehn...this is too bad,but thank God say them nab them oo...
Even mother ser wey go dey advice us join hand do this shit

the girl papa go send am out ,God dey oo

Na the sign of family end tym season 1