Boyfriend give him babe 45million naira motto as birthday gift

in #naijapidgin6 years ago (edited)

DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x.jpeg

My county people I trowey ogbonge salute for unah o
How unah dey?
How unah take d hold body for this we change wey d touch everybody so?

@naijapidgin d tell unah say make unah no worry say hope dey.

So today nah another beautiful day and I know say plenty plenty better d wait for us today and we still d follow pray make market continue d show us green green light.

So d gist wey we carry come today wey we go rub mind together nah for entertainment matter.
images (10).jpeg

Hmmmm my country people while some people dey here d bite teeth, d complain, d worry anyhow some people dey there d spend money anyhow like say tomorrow no dey.

Make I gist you!!!!

Ehen..... Chai nah so news break for internet say one of our musician wey Dem d call David buy motto for girl on her birthday and em call d motto wey him buy assurance.
Wetin scatter people head pass b say d motto nah 45 million naira em buy am.

chai there is God o.

unnamed.jpg

Nah em d Tori come turn everywhere up side down with comment and reactions, people just d chook mouth anyhow,
Some say wetin him do no good

Some say money wey take miracle for bbn 85 days to get with sufferness nah em him carry give girl just like that.
Hmmm as I dey take so me myself I no fit shout.
Wetin pain me b say no be only once Dem d do am
Abeg I want make we turn steemit up side down with our own reaction too
How unah reason d matta and all this things wey our musicians d always do?

no forget to the support us your upvote comment resteem and follow

if you want join us for we WhatsApp click here

nah @oliverwilliams bring this one for us

nah mittymartz give us this fine avarta

IMG_20180215_155325_695.jpg

Sort:  

God don bless am, e see am say na like this e wan take spend e money, make e carry go..... Thank God say no bi thief them say e thief am, na e choice of spending spirit be that😁

My sister no be lie Sha you talk sense there

E be like say the girl do jazz for the guy na why he give her that kind gift....

Chai

I wish one guy fit do like so for me self

I go just sell the car travel go obodo oyibo

Hahaha my sister no kill me with laff o

No die o, abeg

You don learn pidgin by force....lol

Lol
na so o

Learnt in the group na, lol

Sometimes, u go just know say some pple na 'money miss road'... If Davido no see wetin to use bar do, y e no go troway am 4 ocean. I feel e went too extravagant on that 1... Wet in dey pain person pass 4 d Mara na say, most likely, d relationship no go still last, small time na, u go hear say dem don break up, abi Chioma don give Davido smtn chop??.... Mk somebody try caution dis smallie dem dey call Davido abeg...

This one wey b say celebrate relationship no dey last you com d spend day kind money.
Nah only God know sha

Me no see anything wey dey wrong with watin Davido do. The lady na him babe and him buy Watin him feel sey show how valuable she dey to am. Besides him get the capacity to buy am, no be say him go borrow.

I no understand why people dey para about the issue

Tor make e b say we d take Panadol for another man headache bah!!

Exactly... Make everybody face him hustle and mind him business.

If you like buy you girlfriend private jet e no concern anybody

Haahaa dix one no suppose to be mata self, when everybody know say that kind money no be anytin for were 30billion naira gang dey.
Na how e don chose to flex him money oo, bcos if e no stil giv the babe another thing go still collect the money especially since the money dey.

No b lie you talk dere sha

God abeg send me my own Davido

U go fear prayer point nah

Make him use dat one help d babe life before we go hear another news say dem don scatter as usual.

As that one nah there normal Tori abi!!!

Make una free the guy abeg.... The money dey naa. Why we dey make money? No be to spend am?.... In fact that one na small one, me get big plans for my next girlfriend.😘😘

Abeg how much be aeroplane? 😂😂😂

@naijapidgin you finish work for here and i trowey salute give you.

Me na that igbo boy wey dey for kada city @brightfame

I beg make una go change una name to Chioma. Gift go dey com any how any how.

God don bless am na,so e fit dey spend money anyhow. Carry 45million buy car for a girl wey e never marry. He dey do like say e no no girls,dem fit change colour go meet another guy wey get money pass am later. So that means hin money don go be that. Assurance ko Endurance ni