Naija Pidgin 15 words Sweet steemit moment story

in #naijapidgin6 years ago (edited)

oaEY5Y9.jpg
Naija i dey hail oo
Una wehdone oo

Today we no bring ogbonge topic but na giveaway we wan do

So na small thing

Rules

  1. Resteem the post so that plenty people go see am

  2. Write Short 15 words Sweet steemit moment story

  3. Upvote this post

  4. No English ooooo

Winner go take naijapidgin 2sbd by 9pm GMT+1 today

Thanks to @Onequality, @Infovore and @ogoowinner for the constant support

IMG-20180312-WA0006.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

e get one tym sbd na 3koko abeg make i nor go 2 naira

I no kuku understand you

one time surpassinggoogle vote me na so i JST dey jolly

Na so

If better steempower jam you
Na happy go full ur body

boy wey dey beg say make I give am the smallest money wey I get

Ewo

Steem beggers don de here 🙆🙆🙆

Baba the hustle is the tightest

I bin dey enjoy steemit wella so tey na everyday i dey jam new people

That na normal thing

I begin learn Chinese online just to gather chikiny upvote from dem korean whale chaii

Guy the hustle is real

Anything to bring the upvote

i no fit wait to see steemit for $100 am a millionaire

I de hope too but maybe na next 5years

So keep hodling

holding fit last, when guys needs are endless. Nothing is impossible in crypto world

SBD DONG JUMP ENTER #5000, IF YOU GET AM FOR WALLET, BETA SELL AM NOW

U be scam

I just make me go check market

YOU SURE SAY YOU CHECK AM WELL WELL?

YOU BETA GO CHECK AM AGAIN

That time wey @dan dy take more than $100 upvote comments for hin post 4midnight

Those people nai get steemit na

Man go sama beta post, come payout zero dollars. Nna, life na match-fixing!

Nna just kill me

Match fixing for steemit.... No worry na small small

Na when I get $6 upvote for inside one comment, I just dey shout

I know that feeling my brother

Abeg make person help explain for me why sbd dey run go down like dis.

U for call haejin na

😋😋😋

I don laugh tire for una posts so tay i forget to type my own!

Last year December period for steemit bin sweet die, beta bin full grand brerekete.