Shaku shaku origin

in #naijapidgin6 years ago

Topic:Shaku shaku origin

Good morning my country people how una dey this wonderful Wednesday morning we for naijapidgin salute una.

Wednesday don land again and na midweek many of us no fit wait make friday reach fast fast so that we go fit rest and go flex small.
IMG-20180905-WA0001.jpg

https://instagram.com/p/BnRauQJFQG9/?utm_source=ig_embed

The mata wey we bring this morning na interesting one and na something wey dey trend now for our obodo naija e get one particular dance wey people dey dance well well, dem dey call am shaku shaku as we know many others like azonto shoki etc don come and go na shaku shaku now dey make waves the thing serious so tey me con dey wonder how dem take dey form all this dance step as I dey browse na I see where one bobo dey explain the meaning of shaku shaku and where e originate from e say it means 'SHACKLES'that is make dem tie person hand and leg with chain like thief e say na criminals and slaves na im dey make all those movement and if we watch the dancestep we go see as them dey demonstrate am. The bobo say him sef dey part of people wey dey dance am but now when him don know e no dey dance again and this days for churches sef people dey dance am the guy don yarn us say na devil new way of enslaving people so make we stop to dey dance am, and as we don hear the truth the truth shall set us free.

So now my people how una see this mata una feel say na true this guy yarn us abi na lie make una drop una comments.


If you like what the community is doing and would like to support us,

Please follow our trail via
Or delegate SP to @naijapidgin.

We are naijapidgin community with a mission to 'Promote and get the fast growing Nigerian community on this network fully engaged in a language they cherish passionately. As well as help minnows

Join our discord severs for fun, interactions and voice shows VIA
We broadcast both in English and pidgin live on discord channels.

On @naijapidgin discord channel, a lot of variety shows and lectures are ON

  • Every Tuesdays we have real life issues with @preciousimo
  • Every Wednesdays are unavoidable lectures
  • Every Thursday we have relationship talk with @sparkles
  • Fridays is our well known ameebo center by @rebeccafl
  • Sundays is always variety night show by @itoroarchibong and @imbigdee.
  • Same Sunday we have our @naijapidgin hotseat ( featuring some well known steemians)

You ought no to miss any of our programs.

TEAM:
The brain behind the running of this great platform remains the wonderful and dedicated personality, one who truly gives their time and best for Nigerians on the blockchain...
@ogoowinner
@zizymena|@oliverwilliams|@horlaide|@mittymartz|@nmalove|@preciousimo|@rosyblessing

IMG_20180319_092844_398.jpg
Avatar designed by @mittymartz

Sort:  

lol naija mentality sha , me no belive this jere

I swear the mata tire me

Hmmm.. You fit explain why you no believe?

As in ehen!

Great click @naijapidgin,please support my post

Posted using Partiko Android

I be ogbonge Jesus pikin but d way religion dey go enh, e don turn some kind pipu to "sadist".

Sadist na oyibo grammar for persin wey no get chill for body, e no dey like weytin dey jolly pipu for mind.

"No be say shoot bird" (seriously), some pipu sef na wen persin dey feel bad, na den dem dey happy.

Abeg me no gree weytin him dey yarn atall.
Na him mentality be dat.

No be point him make,
Na very vague way of proving point be that.

I don waka

So wetin you dey yarn us now be say na lie.

Gbam, no big fat orobo lie

Lol.. Okay prove your point

Everything for Naija na satanic ,na so dey talk say Dele Alli celebration too dey satanic.Abeg make una no tell us rubbish

Bros calm down lol..