Steemit Flag

in #naijapidgin6 years ago (edited)

Ma Naija people how una dey, I trowey salute give una oooo.
Make una welcome to our ogbonge naijapidgin blog.

As Mondays dey always dey be, so today we go like make una chuk mouth for matter wey concern steemit and our blog.

As the topic don stand campe, I believe say u go don understand wetin dey there, dat flag wey no get colour but dey commot person reputations
IMG_20180319_092814_274.jpg
Image source

@naijapidgin views.

As dis matter don dey ground, make we gather reason am.
Na dis flag key be the worst thing wey I don come across for dis steemit community, I swear flagging no get mercy oo.
How this platform go be if dem no get flag button self?. i.e no steemcleaner nor cheetar.
But sey dem suppose allow person like you and I dey use this key, hmmmn. The fact wey dey behind dis matter be say we dey misuse the key. How u go dey flag person wey offend u, NAWA oo

As una don see dis matter, wetin we want make u do be say:
Make u comment on wetin u see for dis flag key.
Se make we dey use am dey go or wetin?

No forget say make una join us for our whatsapp group, im dey function always
If u neva join click here

Na @horlaide create dis post for naijapidgin

IMG_20180319_092844_398.jpg
Na @mittymartz design dis avartar

Sort:  

The flag button good oooo,but as you know naija people,they go misuse any change wey them give them, but some people self,it dey their body,they go always do silly things may go make people flag them nao,but again some people flagging get as it be,how you go take flag person because he offend you,because you get level bar
The thing be say if we talk say make me remove flagging,people go too spoil aha noo people go rot,but the thing wey go good be say may we get comitee wey go dey look into this flaging matter,wetin i dey talk be say if you wan flag person,you go carry the matter go flagging commitee,so na this flagging commitee go decide weather the matter reach make you flag nao, for example ogowinner wan flag me base on say i do something wey no good,she go first carry my matter go flagging commitee,so na them go decide weather the matter reaching flagging level,if it reach flagging level,them go tell am make she go ahead but if the matter no get weight,they go tell am make she drop am,(Ogowinner na example be that oo,no go flag your girl o)
And wetin flagging commitee being talk na him be final,so this go avoid uncessary flagging like you put hand for my babe yansh so i must to flag you,so all my tori be say may we get flagging commitee wey go dey decide wether its worth flagging or not

@switmag
U don yarn beta for dis matter.
If u give naija peepz an inch, na mile them go occupy ooo

I no go lie when i first join steemit ehnn i no even no wetin be flag until they do am give one of my guy na so my correct guy kan they explain to me wetin it means.

But the thing bad sha, so if you just hate person, u go wan treat him fuck up by flagging the person, that one no fresh na.

To me this flagging get two sides like everything wey dey this earth, good and bad , but more of bad sha , as i take see am

@ehisoria
U don yarn beta for this matter
Kudos

I never experience this flagging before but I no want experience am. If to say flagging and cheetah no dey for steemit omo na better levels be that o. People no go use their brain again na to just go Google copy and paste and wait for money. People go dey spam anyhow and e go make people lazy but again everybody for fit do steemit as e no go be brain mattaz again. Thank you @naijapidgin as una carry this levels come again

@zizymena
Na so nw
Our naija people no wan work again oo
Na jex to collect money. Nice

My pipu I mo ho lie for una...this flagging tin bad tosey e fit make person commit o o,dem flag one of my friend and he pain me because e just get one huge reward wey e suppose collet that week but he lose am because dem flag am..but sha flagging they always come with a matter sha, but I tink say if all this pipu wey get many steem power dey help upvote pipu upvote instead of flagging steemit go better.
But this matter,I even write a post about am self bcause I no like am at all..make pipu dem dey comment instead of flagging person..you no sabi make point by flagging someone , so e better make u just comment make the person no wetin he do.
Na wetin me go yarn b dat.

@badmusazeez
D flaggin pain u oooo
Sori, make una tell dat ya padii 'to be real'
Good!

Nna Ehn me no gbadun that level o cuz if you offend people or some people just dey beef you, dem fit just use this flag flog person two, and you self sabi how hard e take be to dey gather rep, my brother no be small work. Make Steemit change the rule as people go just dey misuse am.
And to that bros wey mention naija , no be only naija dey use am o, no dey spoil naija level online na..

That flag thing no good ooo. E dey treat person fuck up wella. The first time I see cheetah for my post I wan craze, I just use my mother poem join wetin I dey right the next thing I just see cheetah, person kan tell me say I no write reference.

@tutufaith
Cheetar self still be pikin for steemcleaner side
U don try for dis matter..

Omo dat matter mo be here
I never experience am and i no wan experience am
The thing sabi pain die

Una welldone o

@jeaniepearl
Ok,I pray u don't experience such
U don try...

make i no lie, if to say something like flagging no dey, this steemit no for make sense because the thing for just be copy and paste!

@abdane
Na wetin wan sure pass be dat abi
U don yarn beta for dis mata

I greet una o
I never experience dis flagging of a thing before.
Even the robot una the call cheetah, I dey only see am for person post.
I no even wan experience dat kind thing Na e make I dey try to make sure say I use the brain wey baba Goddey give me well so that I fit outsmart those things.
Them for try remove flagging but make cheetah dey there so that people fit try serious

Omo this flagging thing good o, imagine say flagging no dey some people go dey do copy and paste well well, i read one funny post wey cheetah flag one person post and hin still dey tell cheetah thank you, abeg i no fit laff, i sha try to enlighten am sha. @naijapidgin una doooh o