My NPC entry for today: Wetin friendly enemy don do me.

in #npc6 years ago

PSX_20171210_151650.jpg
As black people wey we be, God for heaven give us power make we fit dey pretend. We fit pretend for woman for 7 years say we love am and we wan marry am. Woman go dey give us body, dey cook and dey do everything wey we want but at the end our true color go show: 'baby no be your fault, na my fault'. It dey very bad to know say 80% of people for Nigeria be back stabber. Dey go first come with smiley face say they be your friend but wetin dey need na your downfall. The sad thing be say you no go sabi how to tackle them because say you believe all of una dey the same road. You go open up to them, tell them everything wey dey worry you but wetin dey go use am do na to plot your downfall. Every human for this world need friends, they need support and they need personal person wey dey go fit tell anything wey dey worry them. But many people go fall for the hand of friendly enemies wey go pretend like say them get your back but na to finish you. So my advice to people be say, no matter wetin dey heavy you for belle. Keep am, no tell anybody. If the thing to heavy, pray to God na babe wey dey heaven na him sure pass. People don suffer for wetin dem no know because say them go open up with enemies wey dey pretend as friends. Make we shine our eyes and dey careful.
I wan use this opportunity thank madam @ogoowinner for this challenge and I wan call people: @houseofbella @uniquegem @setapart @destinysaid @texmax @sweetinnovation @ejemai @ehiboss . Make una share your story too how you take dey see friendly enemies for my comment area

Sort:  

Oga na better tory be this oo,friendly enemy full for this world.Keep up the good work sir,will be waiting for your next post.

Pipol no dey trust worthy at all...na why i don shine my eyes wella for anything i won do especially with pipol..i salute you oo @africanchild