Friendly enemies: Naija pidgin english contest

in #npc6 years ago

My people, my name na Gracefield.
Mk i tell una say me i bn de so happy wen in see the topic for this contest because most of us go don experience one thing or the other from our so called friends.
Na my own story be this o,
I bn get this friend wer i trust so much, infact we bn de so close till people come de think say we be sisters.
We attend the same primary school, d same secondary school, d same church.
So wetin come happen be say after secondary school, we go write jamb, apply into the same university and even the same course.
As time for admission come reach cos i no bn too score well but my friend bn get admission because one of her uncle bn help am out for the admission runs. Na im my friend enter school o.
Wen time don reach for 2nd admission list to come out ,i come beg my friend mk she give my name to her uncle cos him bn still get slot for the second list.
She come assure me say she don do am ,dat my name go come out for the second list. I come believe am come happy. Everytime wen i remind am, she go tell me say mk i no worry say dat side de settled.
Finally as d list come come out, behold my name no come follow, as i go meet am she tell me say she no understand why,dat she bn try her best.
I come take am in good faith de wait till next time.
One day i come jam one of my neighbours wer enter that same school, as we come de jist, na im she come tell me say she been give this my best friend money to give her name to her uncle.
And na why her name bn come out. Na now i come know say my best friend been replace my name because of money and she come the lie to me all this while.
I no fit stop to cry since that day and wen i ask am she come de tell me say she bn need money to pay her school fees na why she do am.
Abeg mk we de careful cos some friends fit de very terrible and if we no de careful dem fit hurt us so badly.
images-5.jpg