The Creed of life: my entry to Nigeria pidgin challenge organise by @ogoowinner:

in #npc6 years ago (edited)

I believe say everyone for this life get the right to be seen, heard and loved.

I believe say all humans for this world they equal. All of us gather dy the same.

I gree sey everybody get the same shares, for this world wey you and me come so.

I gree sey for this life, everybody na oga for him area.

I gree sey as everybody get im own craz na so im follow get him own better. Me wey you see so, na my better I go follow yarn oooo so my craz go fit find place sleep.

I believe say race, religion and social status dem be nothing but the creation of contentious men to take dey control others, cause strife and in-plant the supremacy mentality. So I go choose be "human first" before I go be of any race, religion or class.

I go treat people as I go like make them take treat me.

I no go react to people based on who them be, but based on who I go want make them become.

I no go involve myself in any business or project wey go cause harm to another person.

I go try my best dey gallant even if notin dey work or wen notin no dey okay.

I no go dey allow fear take over my mind set.

I go dey use better thinking tackle any bad thought wey dey kom mah mind.

Me go always dey my lane!! No crossing of path.

I believe say Peace dey

I believe fit i helep person

I believe forgiveness Na something werbi fit de

I believe say love de

I believe say i fit show mercy

I believe in justice for everybody

I believe in my people and our human race

Me wey be Blessing go follow dis creed till dye day wey I go comot for dis life. image