Naija Pidgin Challenge: All the plenty plenty killings wey dey happen for naija

in #npc6 years ago

Screenshot_20180211-051738.png
Yes oh! Our ogbonge sister @ogoowinner don com again! I throway salute oh! The topic for today na all the plenty plenty killings wey dey happen for our naija.
But,come oh,make i ask una: Wetin dey happen sef? I bin dey hear of these killings since oh,but now,e be like say government no get control again,me i think say dem all confuse. They say na foreigners wey dey kill people pikin anyhow,but i dey read say na our own naija people wey dey do this kain yama yama thing.
Screenshot_20180211-051724.png
See wetin i see this morning: since 2013! 2013? Hai God! I no believe am,i start to hear am from 2016. Make we carry eye go back to the creed of life wey we write so that time,because me i believe everyone get right to live,so i no dey understand why fellow naija people go dey kill other naija people.
Make we read that creed of life well well,because no be only to write am,na to remember and respect am,na wetin me i believe. People dey run comot from their home,and for wetin? Bad belle naija people wey dey kill other naija people?
Make we stop all this killing,make government help their people,how long dem mamas go dey cry for their pikin wey don die,for their husbands wey no go waka come back home,for their friends,relatives them? Ehn? E never do? Ha!