NAIJA PIDGIN CHALLENGE EPISODE 3: THE CREED OF LIFE.

in #npc6 years ago

IMG_20180129_172210_720.jpg

Yes oh, I don come again my people. This one na part 3 of naija pidgin challenge wey our correct sista @ogoowinner arrange for us so.

For this one so, @ogoowinner don arrange one beta package for us wey she call 'the creed of life'. This package dey try tell us say make we love one another and make we dey see one another as brother and sister.

This kain thing go show you say @ogoowinner na beta pikin.

Oya oh, make me sef arrange my own creed, make I show @ogoowinnner say I stand for her back gidigbam dey support this creed wey she write so.

I believe say everybody get right make people see them, hear them and love them.

I believe say everybody wey be human being na one and the same.

I believe say space dey for everybody for this world.

I believe say everybody get one particular area wey be say dem be oga for that area.

I believe say everybody dey special and unique.

I believe say everybody get demon come still get angel inside their body. So me I go try make e be say the demon inside my body no too dey show, na only the angel wey dey inside my body go dey show.

I believe say race, religion and social status na wetin bad belle people use their hand create so that dem go fit dey control other people, dey cause unnecessary struggle and to put for people mind say dem beta pass other people. So as for me, na my fellow human being first oh before any race, religion or class.

I go dey treat people the way I go want make dem treat me.

I no go dey answer people based on who dem be, I go dey answer people based on who I want make dem be.

I no go dey part of any business or project wey go cause another person harm.

I go try my best to understand people, no be to dey judge them.

I no go gree make envy, jealousy and greed dey control my motives.

I go do at least one beta and correct thing for humanity before I commit for this earth.

I go try my best to dey strong even if I dey experience bad luck, grieves and sorrows.

I no go gree make fear come dey intimidate me.

I no go gree make any bad thinking dey my mind at all, instead anytime wey e be like say I want dey think bad bad things, I go start to think good good things make those bad bad things commot from my mind because me sef I know say "thinking get power'.

I go be myself all the time, as in, my original self no be photocopy of anoda person.

I believe say if I put my mind well well for anything thing wey I dey do, difference go dey.

I believe say this life na journey, no be race, so I no go dey do unnecessary competition with anybody.

I believe say peace suppose dey.

I believe say charity sef suppose dey.

I believe say we suppose dey forgive one anoda.

I believe say we suppose dey love one anoda.

I believe say mercy suppose dey.

I believe say justice na for everybody.

I believe well well in this our human race.

I decide say me I go "live", no be ordinary "exist" wey I go dey exist.

Me, wey be say my name na Joy, go do all these things wey I don write so all the days of my life.