THE CREED LIFE: Nigerian Pidgeen Contest(NPC) #3

in #npc6 years ago

First of all make i throway salute give our madam @ogoowinner for this competition were she carry come our Steemit doormot.
I believe say everybody get right for people to see dem,hear dem n love dem.
I believe se we all dey equal.
As i dey like dis i believe say this world big enough to contain all of us.
I still believe say all of us sabi something for one part of our life.
We all dey unique n special.
All of us get good side n bad side,but we dey always try to de hide our bad side, cum show only the good side.
He no matter our race,religion and social status all those thing na noting becos na all dis contentious men na him create am to control us, cause wahala and wash our brain.so as for me I won b human first before anything.
I go treat everybody the way I want them to treat me.
I no go dey vex for people becos of who dem be, but Wetin I want them to be.
I no go follow for anything wey go cause wahala to person.
I no go allow envy, jealousie and long-throat they control me.
I go do something for this earth wey good wey dem go use remeba me before i commout for this earth
I go try dey strong when wahala,badluck and problems show me their face.
I no go dey fear anything.
I no go dey allow all this bad thinking to dey worry me instead I go dey think good things becos dat kind thinking ney him make sense.
I nogo dey form like say I be anoda person. I go show ma self any where I dey.
I believe say i fit bring change,if i try very hard.
I believe say dis life na jejeje no b to dey rush becos i no dey follow anybody rush.
Me b person wey no like wahala.
I believe say he good make we share the little wey we get with People wey nor get.
Me ney dey like carry person for mind i prefer to just forgive.
I like love oo.
I dey for mercy.
I dey for justice for everybody.
I believe in all of us.
I like to live life knor be to just dey exist.
I Kelly Usikhifo(@kelly007 go follow dis creed for the rest of ma life.


credit

This picture na our main artist "Tekno" base on Rara something.