Naija Pidgin challenge Season 3...

in #npc6 years ago

bbbbbbbbbb77777.jpg
Myself and my son

@ogoowinner u too much,

I no do this shallenge before so make I try am today, my name na Rosemary Ekanem, I be mama nurse for Teaching Hospitu, Mental unit.

How una Sunday de?

Naija how una de enjoy this we new year?
Na so so dry dry everywhere, even Civil servants no de smile oo, but you see this we Steemit? Na God carry am come ooo

Una see this we steemit? Wey we get better guys like @ejemai for #stach and we own @ogoowinner? E go continue to develop give us joy. I been hear @ogoowinner mention yeye friends them, abeg make una no do mistake with yeye friends this new year ooo, no do that mistake oo, bad friends fit kill you.

Plenty people don die unto bad friends wey dem been get, abeg my pipo, sabi say friendship na choice no be by force, munna de well abeg, God go bless we hustle.
Make I post pishure of one better Nija pikin wey too make sense. She be #Omotola, mama of 4 pikin dem.
FB_IMG_1517154187492.jpg