Economics hard gan- in pidgin

in #writing5 years ago

IMG_20190325_235755_424.jpg

School no easy o.. And this economics wey I de study sef no de give person joy.. The course hard like no man business. So so calculations and abstract theories and diagrams. Person wey graduate with 1st class for economics supposed de get award for naija.. Lol

No mind me, today I wan hype my course/department.. But I no overhype o. na true I de talk.. If you think say I de lie ask person wey study economics for school. I know say people wey do engineering, medicine etc go say economics no hard pass their own course. I know wan hear am Abeg, Economics dey hard. Periodt.

I go soon start to write my project, my supervisor Don talk say we gats submit chapter 1 to 3 for this first semester wey we de. Before I de think say project na second semester matter.. Them no de even give us time make we do anything, we de get classes bomba to bomba and exams go start next month. Which time I wan get fo chapter 1 to 3. I don tire ooo
Make una de pray for me, e no easy I swear.

This na my present condition... For those people wey de talk say, 'if my course hard why I never slim down finish, e no concern una. Leave my body like that, na by force make e show for my body?

I say make I use pidgin write this post for people wey talk say I no sabi speak pidgin.. Make una come see oo

Rate my pidgin Abeg. Hope say I try? 😝

Sort:  

😑...lol, econs sha
Whether med or eng all of them hard scatter
Hope you smash for your project😁

Lol. Thanks dear