You are viewing a single comment's thread from:

RE: Hive-Naija Weekend Engagement #69- “TRUST ISSUES”

in Hive Naija6 months ago

Omooo...emme take water fess for two minutes, hehe...

See this bestie thing ehhn, especially with the opposite sex, na issue from time. Not all cases sha, but in most dem just dey lie to each other or one person dey genuinely deceive the other. Na so I see it observe am sha.
I think for whatever reason I end up with another lady, then even if I have a bestie she no get choice but go relegation to a friend, in a case we don marry especially. Just to avoid stories that touch later. This human feelings and emotions no be play oo, lol.

And then sleeping over? For wetin na? How inwan come dey explain say I sleep for my supposedly bestie side. I go just explain tire. Na wetin dem dey call playing with fire and I no ready to burn or catch fire 😂😂.

With dis small mouth wey I chook hope say I no cause wahala but I direct the matter too small...😁

Sort:  

You direct the matter well because I been dey look you with corner eye to hear wetin you want to talk but last last, you talk well. So gbosa for you 🤜🤜

Omoo thank God dat corner eye no catch me sha. Only two gbosa? E suppose reach like 10 na 😁

🤜🤜🤜🤜🤜🤜🤜🤜

E don complete like this o.
😂😂

Okay, you add dem to the two...

Nice e don complete 😁😅

Let's call a spade a spade....

There's no sense in keeping a bestie of the opposite gender especially when you are married or in a serious relationship.

Your partner is your bestie, whom you forsake all others to cleave to.....period.

That's just it. Where I come from we'll say ‘shikenan’

And to think of it, if you call someone else a bestie, that means is someone you comfide in and can tell deep things. So you then leave your husband or wife or relationship partner to confide in the bestie?

So unreasonable...

Very very very very very unreasonable 🤜

This ‘very’ longggg sha 🤛