My own Correct Creed when i go dey follow... Entry to @ogoowinner npc episode 3.

in #motivation6 years ago (edited)

My naija people, una well done oo. How una dey? I hope say una dey enjoy this correct weekend. Abeg this na my entry for @ogoowinner pidgin creed. I don think am and come write my own. Abeg make una read below and make we reason am together ooo.

Inside my mind, i know say na everybody, na im suppose get love and na im suppose get people wen go like am and hear him talk.

I know say na everybody when dey this world, no body suppose important pass each other.

I know say as this world be so, e big well well ooo. E dey big sotey e fit contain all of us wella.

I know say nobody be mumu. Everybody get wetin him sabi well well.

I believe say all of us dey special oo. No one of us dey anyhow. No matter wetin time dey talk for our side.

I believe say as all of us dey so, we get angel for our body, na so beast too dey inside us. All of us get our correct side and our wowo side. So we go dey try our best to show only our correct side, and hide the wowo side.

I believe say money and power na something when fit put wowo thinking for our mind. Na some people make am so that them go use am dey wicked others. We suppose try to behave like ordinary human being and love each other, before we begin reason to collect power and money.

I go dey do people as i go like make them do me. So E go be do me i do you.

I no go dey follow people ontop who them be, i go dey follow them ontop who i want make them be.

I no go follow do anything when go make other people suffer or vex.

I go hustle to know people wella, i no go too dey rush to treat thier fuck up.

I no go let envy, or jealousy to put sand sand for my garri ooo...

I go make sure i do one over correct thing for pipu, b4 i waka go meet baba God.

I go try to hold myself, no matter wetin happen or wetin my eye see.

I no go let fear do me anyhow.

As i know say wetin i dey think too strong, i no go allow yama yama thinking to spoil my mind. Anytime yama yama thinking come, i go begin think correct matter so that yama yama go run.

I go always dey do my thing, i no go follow follow anybody.

I believe i fit change matter if i reason am wella and put correct work inside.

I believe say this life, na jeje oo, no be who go win oo, because no be competition.

I believe say peace, love, joy, and better things fit happen if all of us put hand together.

I believe say better people must win.

I don decide say i go live life wella, i no go be zombie.

Me when be @evelynbelle, must follow this yarn wella.

As i don write am here, i go dey try to follow am, because i know say anything wen person dey talk all thr time, small small e go begin dey happen.

20180128_191426.png

Image Source

This na one correct fine fine aunty wen dey act film. Her name na Caroline Danjuma. And me i like am wella.

I want thank @ogoowinner for this chance when she give person to come talk matter for here.

Make we join hand together and make our life better oo.

I thank all the better person when don read this post.

Una don do well.

Una welldone oooo.

Sort:  

Girl, you nailed it..

Thanks sis 😍