DOUBLE WAHALA

in #naijapidgin6 years ago (edited)

My country people I trowey salute for unah o.
How unah dey, how unah take de hold body for this change.

We don come back today again with another ogbonge gist wey we go want make unah chook mouth put,
but before we yarn unah the better amebo talk wey we carry come , we want make unah know say all of us for the naijapidgin community want thank unah well well for the love wey unah dey show us for this place,
This community nah for all of us no be any person own,
so to my northen people I say nagode.
my western people I say ese.
and my Eastern people I say ndiewo.
Today I want make we yarn about this our own tv show wey them the call big brother naija (BB Naija)
wahala.png

This tv show don d happen tey tey since when the tin be big brother Africa to now wey dem come change am to our big brother naija,
This one wey we want talk about so dem call “double wahala”.

E b like say some people like the tv show why some people no like am, na so the thing just the cause mixed feelings for we country, but why the thing the funny me be say the people wey like am come d plenty pass the people wey no like am.
Na so e come b like say nah em come be the number one tv show for we country now,
But my people how unah take see the program? Wetin unah get to talk about the program?

Me wey the talk so I no come understand why dem go pack adult put for one room for 90 days make dem the do wetin dem like at the end dem go come give them money,
me self take style the watch am small small sha, but abeg eh because of wetin dem dey do unah think say e good make our children dem the watch am?
if you get chance to change something for the show wetin you go like change?
As you dey try talk your own put make you also try tell us your own favorite housemate for the house and why you go like make dem win the money.
Make you yarn you mind for this mata

“Naijapidgin! your number one Amebo house”

Naijapidgin we go always dey talk the talk

10% of this post payout go go to the person wey him comment get enough people dey follow am argue inside and the one wey get plenty upvote.

Na @oliverwilliams write this one for @naijapidgin.

If you go like join us for Telegram, clickhere

DQmQkNYBpYh7mPEJV6KFqxCfneCsy8kYxgzH7Lg91z6zf7o.jpg
@mittymartz na im design our avatar.

Sort:  

My country people i hail o, i no sabi why we people dey talk bad bad for the show o, as for me i like am wella because sey e dey entertaining and e dey help relax, pesin go don dey serious for work since morning, na to come back house relax and enjoy the show before pesin go sleep, as for people wey dey talk sey e no add value to we country, una suppose know sey dem dey pay their tax and to those wey talk sey e no dey educational, no be all shows dey educational many stations dey if you no like wan make you change am to another wan, the show no be compulsory to watch plus sey the organisers sef talk sey the show no be for pikin sey na people wey don sabi as e dey go the show dey for so make una no dey let una pikin dolo una watch am if una won watch am,una fit folo me talk if una think sey i dey wrong or right make we scatter the matter and reset am back, naija i hail o

The matter tire me fa. The show no dey add any value for our country economy at all at all. Na last year i hear about the show but when i come watch some part of the show. The thing vex me die. Children wey win competition for school no dey win the kind of money wey these people dey win.
Make them kuku ma stop the show instead of telling children make them no watch the show but as e be now. Make our parent them dey stop their children from watching that show because e no go help our moral standard for our obodo 9ja. Na my mind i just talk now. If the sponsors no know wetin them go do with money. Make them kuku ma give me the money to increase my steem power oh.

Me sef don tire for naija, i no dey watch am, for me na waste of time. E no dey add value for my life.

Abi nah true talk jare meself no see value oo

Me n u Dey d same page on dis mata I swear, na y I no even comment on dis post...dem no go encourage pikin dem wey Dey use dia time do better thing but dem go go park millions give some bunch of spoilt brats wey Dey do nonsense smwia....

For we ogbonge country now, the show relevant gan oo because people go see wetin go make them laff. As money no dey, food no dey, light no dey if persin no look for wetin go make persin laff now na to go die be dat oo.Una eh make the show kontinue. some pipu go argue argue about the show sooote de go forget say dey never chop.

nna eh, dis thing wey you talk na true talk o, wetin make the thing take happen like that wey they chage am from big brother africa to big brother naija be say na change we dey, so evrithin go be change change.

na only baba GOD go help us.

So the change affect everything sotey e affect tv program,
U too much my paddy

na so me take se am o, abi the change no affect you?

anybody wey talk say the change no affect am make he raise he hand up make I see

I no kuku first like am, naso my mama dey tell me say she dey watch am maa come join am, na so i take dey like am small small, the amebo part dey make sense, for me sha, the show don dey alright but then i sabi say no be dem true nature them dey show for tv, shebi dem all sabi say na game, them no sabi the amount of support wey them get, so wetin dem dey do be say them dey bring out the bad part of other persin for house, na wetin dey happen for cee c be dat, though she dey pompous small but why should be that her refusal to be involved romantically with tobi come make them hate her, maa come dey go, before i spit too much oo.

The tin be say,na just reality show say the aim na to see hw pple dey relate with each other so me no see crime for am...and for the bad bad tin wey dem de do whe no good for our pikin dem...na y e get channel restriction so we block am

Hmmm,last year BBN been no dis year own.last year been make sense small.we see the suspense and plenty yeye thing but at least plenty naija people bin chock mouth and body inside am.
This Yr own,Dem no even reach one week,dem Don begin straff for toilet. En Don the spoil Na and people no dey follow again.this year Na triple wahala

you see ehn, to me the show na yeye show. e dey tell us say our people no too dey reason well. Man go think upon the plenty wahala wey full the country everywhere, our people go fit reason to put energy for something wey go better the country, but na lie, na yeye show dem dey do.

When dey finish last year own, I talk my mind on it for twitter so tey but na wetin people wey get the money won use their money do.

Abegi les talk anoda one

The first thing be say most naija youth no get one better work to do. Na so we go dey find things wey go keep our mind busy and occupied. This reality show not too bad at first but as the thing don dey tae na so so different activities dey come join. The only aspect wey me i no like seeing them showing on live television na the immoral aspect wey dey exposed small pikin.

My favourite housemate na miracle

I like the guy based on how composed he dey do for the house and he get the friendly touch wey everyone wan dey relate with

As i dey so, i just dey enjoy the program. Everything them dey do just dey sweet my belle. As i kuku no get work now

Unah too try abegi @naijapigin. The matter nah true talk o.
My favourite housemate nah miracle o. I no even know why i take like ham.
Maybe because we be namesake sha o.

Though me know dey follow d program up, to me 4 d program, I know see anything too bad..
Many naija people they like to condemn d program but make we know also forget say this same program they also show case talents of this individuals wey they the house.. See "efe" , if know be bbn, who know say him be musician...

That one sef na small.. The one wey vex me pass na when our naija girls they quick to judge d fellow girls... Like say they be saint.. .

My country pipu
I greet una with big respect o.
The noise of dis show sef don tire me.
personally,abeg I want make una wey like the show tell me the aim of the show.
because I no understand.
everyday wetin we d hear Na How dis one kiss dis one,, how dis one wan make love with dis one.
Dis tin Na form of programme wey government suspose set up to empower the youth of our great country?
I sight you @oliverwilliams

As for me, i like the show. I dey watch am anytime wey i get chance. Dem don already rate the show 18+. So i dey wonda why we go wan allow our pikins dem watch am in d first place. As for the touch body wey dem dey do, i like am wella. Na d fun part b dat and the games too. So make all of una chilax, go look for oda ways to make your own money, make dem make thier own. All na entertainment for a Nigerian wey wan kpai for this wahala country.