Make una help others with the little wey una get

in #naijapidgin8 years ago (edited)

Hello Steemians,
IMG_20180227_065435_400.jpg
SOURCE

I would be writing about the topic which literarily questions us on the number of people we have assisted or helped in one way or the other. This piece shall be written in Pidgin English which is also known as Broken English in Nigeria. I'd provide a summarry of my write-up in English at the end for as many people that do not understand this variety of English.

IMG_20170214_150855.jpg
@williams-owb and friends at a Motherless Babies Home in Ile Ife, Osun State, NIgeria

Make we dey yarn am as e dey hot

I greet all of una confam Steemians. How una dey? Dis world wey we dey go don beta pass as e dey now if to say we dey help people wey dey around us as God dey bless us. One ogbonge mistake wey we dey make be say we dey wait for millions of naira or even SBD wey plenty before we fit help people wey come ask for help. I wan yarn una say you fit help people wey dey around una with the little one wey dey your hand, no be say you go dey wait until you get am plenty. The thing be say no be only people wey you give something or help go enjoy am, una go benefit from the good wey you do. E fit be say una go dey happy say una help the person or e fit be say una go con get beta parole with the pesron.

SOURCE
Wetin I wan make una sabi be say when una help people wey ask for una help, your mind and body go get peace. People wey dey help others no dey get problem, dis na because e get beta effect for body. Person wey get wetin dem dey ask am and e no do go get headache so tey e go waka if e see say the person wey need hin help dey come. Dis one no good at all. Make una do little if you no dey kampe to do everything. Person wey dey help others wella go get inner peace and hin go get confidence so tey hin no go dey cover eyes where he suppose dey talk.

SOURCE
Una go get bond wey thick like blood with people wey dey around if una dey help others. If una dey concern about the growth of person wey dey around una, una go get more friends wey go comot whenever you sef need help. Na wetin sweet about helping others bi dis. When una get friends and beta rapport with people wey dey around una go get sense of belonging so tey depression and loneliness go disappear from una life. Wetin bi the usefulness of money wey you gather wey you no fit enjoy. Na why the oyinbo people talk say, "there is love in sharing".

Make I no forget to troway dis one wey be say una go dey thankful to God when una help others. Una go get reason to thank God wey provide wetin una get. Una go understand say wetin una get no be by una power, say some people no get wetin una get and una gather dey dis world together.

I go like parkwell for here as I don yarn una wetin helping others go do una and not only all the person wey you help. I salute una for reading.

SOURCE

Summary

All I have been saying is the need for us to help others no matter how little it may be. We dont have to own the whole world before we can render help or meet the needs of others. There is a saying that little things count. You can help in the little way you can, it is better than doing nothing.

Some of the benefits of helping others
  • You build a stonger relationship and bond with people around you.
  • Depression, frustration, loneliness and the thoght of suicide would be far from you since you have an healthy relationship with people around you.
  • When you help others, you also feel happy as you have successfully made someone smile.

Make someone smile today.


SOURCE

Sort:  

My broda, Na true talk you yarn. I wish say this idea of helping others, especially those wey dey in need or less privileged go dey imbibed by people wet surround us oo.

The world would be a better place for us to live in if we stop being selfish and share the little we have with others. Be it money, ideas etc
Thanks for your comment.

Cheers!

Yu talk better tin my broda. We gats dey epp our fellow brodas even wit d small tin weh we get. We no need get plenty to b4 we epp odas.. Yu yarn well broda.. I giv yu 5 gbosa👊

Thanks for the kind words bro.

Well said,you dont have to wait till we are kings and queens before we help others,start from the little you have

Exactly my point @switmag. This is a concise summary of all I'm trying to say. Thanks for your time.

Happy New Month and Best wishes! 😄