Steemit don make school sweet pass before.

in #npc6 years ago

skul 1.jpg

Na me be the person on the right for the pix above; I be final year student for University of Uyo; I dey study Biochemistry.
Before I sabi about Steemit, I dey always dey in need of money for school; money wey my parents dey give me no dey reach anything but how I go do I gats manage.

My brother @joshuaattat come introduce me give Steemit and since then life don better; I get extra cash to buy the things wey I need for school. As babe wey I be I need some kind small small fine things wey mumsy & popsy no go give me money for as their own concern na school fees and feeding money; Steemit don give me money to take care of those things; I no need follow bobo up and down to get am LOL.

Also, as final year student we go write project and if you dey skul for naija you no know as project dey suck money but thanks to Steemit I don dey save money for am small small and I no say wen time reach I go do am with ease.

beiyi1.jpg

Since I sabi Steemit," I dey shine I dey shine I dey shine oooo; when people dem ask me wetin dey make you shine, I just dey tell dem say... NA STEEMIT DEY MAKE ME SHINE".

@ogoowinner na why I like Steemit be that ooo; SBD's fall on you for this challenge wey you put up so.