Wetin friendly enemies don do me

in #npc6 years ago

images (1).jpeg @ogoowinner don talk say make we chuk mouth for this frienemies Mata name wan use the opportunity share my experience o.. I been get one correct friend wey we don sabi our self for almost 10years we close well, correct guy, him sabi give like say tomorrow no dey, naso I introduce am give my babe. Before I know, my babe don spoil me finish for my paddy face, as she no wan get rival. Na so my paddy start to carry eye for me o, babe sef start to dey show hersef. Before I know, dem comot me for circle, come start to run package. Small time, gbege com burst, my paddy come dey clear me everything wey my babe don yarn for my back.
Frienemies dey everywhere make una shines una eyes well o. God go help us

Sort:  

Frienemies, hmmmm, I like that

May God help us thanks for sharing. Follow

Na so dem bi,my dear. But dem dey hep destini sha somtyms

Lool.girlfriends I don't get y some v to spoil u ,is it to gain favor or ? @deegurl I sha Don like ur post now

I tire o.. Thank you dear for the like

Lol...i like your style joor

Na wa oo. People dey sha

Lol, as you bin give dem space nkor? wetin you bin expect?