I dey hail hoo... Una my fellow steemians hope say una dey kanpe? I dey hail my madam way sure pass @ogoowinner for this challenge. Baba GOD for heaven go continue to dey elep me to dey control your hand go were borkoo money dey in this year way we dey so. As you don talk am say make we yan the things wet they tortorii my body for steemit.
AS EN DEY HOT MAKE I QUICK YAN UNA RIGHT FROM THE ROOT OF THE MATTER.
Before I join steemit.
Yes oo... before I join steemit, I been dey write articles as I been dey do, dey hustle for money up and down. A time like that on of my roommate for school talk say hin go send me out of the house say as per house matter. I no know waytin I go do. I just beg am say make bin give me time to look for place to stay. As I fin one place nah hin I park my things comot from the guy place. The guy way I move go gin place that one tell me say hin parent get farm for house nah gin i just talk say make I farm for school ooh. As I arrange the farm way school give me I just plant tomatoes for the farm. The guy way send me out of his house self come ask tomatoes from my hand when I have st am.
why and how I joined steemit.
The reason way I join steemit be say, my cousin brother @sammielaboi dey steemit. Nah him tell me say steemit nah one obodo oyinbo platform way pesin fit dey make money with out risk. Hin add say the thin no be seresere at all say ogbonge people there way fit elep make money yafun yafun. Then I bin think say hin bet lie. Oga nah true ooh... I don see am with my two korokoro eyes like this say steemit no be M.M.M. at all at all I no fit loss any thing for this platform.
why I like steemit.
Hum... steemians, this platform no be seresere at all. Borkoo people don make am through steemit ooh... if I hustle wela for this steemit, I go fit pay my school fees and house rent for this session. No body go get lever tell me say make park komot for house. See beyond waytin my eyes don see and waytin my ears don hear about steemit,
· Pesin fit turn multi millionaire in less than two years for this obodo Nigeria way we dey so.
· If you be book writer, songwriter, artiste, or multinational speaker, you fit make am for steemit.
· Students self fit make am for steemit like me.
· As obodo Nigeria way we dey job palaba no be small yawa dey their, you fit join steemit without submitting any C.V. or payment of any money.
· You fit be civil servant and still dey do steemit dey make your money, even if you dey your shop you fit dey do am.
· If yon advertise your products, you fit do am on steemit.
· If nah project or any research work way you do and you need pesin way go elep you approve and publish am, ogbonge people they steemit it way go elep pesin.
See my people, steemit be the best. Hin no be punzi scheme. Abe yan your people for your area say steemit be the best. @ogoowinner thank you for this Mata for ground. Your hand go dey up for this Nigerian pidgin English challenge.