My own creed for pidgin : NPC organised we by @ ogoowinner

in #npc6 years ago

I believe say all human being them be the same no matter where dem from.

I believe say all humans dey very equal.

I believe say the world wey we live in dey big enough to carry everybody wella

I believe say everyone be genius even if na say for one area of life.

Me belif say everypeeson bad and better for hin own side. Me go try kill the bad side and i go bring out the better side wey me get.

Me belif race, religion and as peeson be no get head and how hin tey dey do gragra ontop another man person, na hin dey cause WA ha la and gbege. Me choose to be human first, before me go join race, religion abi class.

Me go treat people as me want make another peeson tey treat me.

I believe say na everybody has right to be seen, heard and loved

I believe say all human dey equal

I believe say the world big enough for all of una(all birds to fly)

I believe say everybody get a particular aspect wey we good at

I believe say everyone dey special

I believe say everybody have bad and good spirit wey dey arouse them. I go try my best to camp d bad spirit and show the good one

I believe say tribe, religion, and position are nothing but for human be to always dey satisfy with wetin he get, so he go control others... Cos if not hin go dey cause wahala so "human first"

I go dey treat people as i dey treat myself

I no go discriminate bt treat everybody as i want them be

I no go put my hand for bussiness wey go dey harm people

I go calm to understand people, and not judge instanly

I no go allow envy, jealousy, greed dey control me

I go make sure say a make a good impact for this life before i comot

I go sha make sure say i dey kampe whenever matter dey get worse

I no go allow fear catch me

I no go allow bad thoughts for my mind, o go replace bad thoughts with thoughts wey make sense cos i believe say "power dey for thoughts"

I go always be myself and no fake life

I no say for dis life ehn person just gats de do jeje, make fight no de no mata wetin fit happen i go de go my own jeje

to get peace na the baba of all thing .

to de help person de very important

to de forgive person and forget de very okay

to de love na hin sure pass love your neigbour

to de do mercy sef na good thing

And me @madly promise say ji go' image