Steemit don beta my life well well!

in #npc6 years ago (edited)

viky 6.jpg

Ever since I finish service start to work, I dey always need save for minimum of 6 months before I fit buy some kind tins wey I need for myself. I dey work for nursery school and I dey teach pikin dem for dere; I love my work no be lie; I love to dey impact the life of Naija future generation but me dey also wish say the pay dem dey give us dey reach our passion for the work; sometimes dem do owe us reach 3 months and if no be say I dey go work from my parent's dem house e no for easy during those times ooo.

viky 1.jpg

But since wen I start to do Steemit life don beta well well; I dey some kind tins wey I no fit dey do before wit ease.
Steemit don beta my life finish oooo...na why I like Steemit be that. @ogoowinner blessings go dey follow you for this challenge wey you put up so.

Sort:  

Amen o! Good entry better pikin.