Naijapidgin dey share ten (10) SBD. Where you dey?

in #naijapidgin6 years ago (edited)

DQmUKSUbJf6GJypWe3AotmHNRN95riKkHAk52cqMRqfHJ2x.jpeg

My country people. We trowey salute o.

Today na Sunday so make we use this opportunity wish our Christian babes and guys wey dey celebrate Palm Sunday, Happy celebration.

Una don too try for we blog and because of that @naijapidgin don decide to reward una through contest

E simple well well. The koko of the contest na hin b dis

  1. Make you tell us for the comment section wetin make you like naijapidgin community.

  2. Write wetin you think say we fit do to make this community better pass as ein dey now.
    Yarn us who tell u about this group.

  3. Tell us wetin we dey do wey you no like or wey you want make we change.

  4. You go come upload one of your fine picture take seal the comment.

How you go take quality for the entry.

  1. You go make sure say you dey follow naijapidgin.

  2. You go upvote this post.

  3. You go resteem this post.

the comment wey the upvote plenty pass and people talk well na em go win our prize.

OUR PRIZES NAH

1st winner 5sbd
2nd winner 3sbd
3rs winner 2sbd

We go announce the result after 7days from when we post am.

if you like join us for we WhatsApp group just touch this link enter

nah all of us and @zizymena carry dis one come unah domot.

Nah @mirttymatz give us dis fine avarta
IMG_20180215_155325_695.jpg

Sort:  

Ur boy Don show o, d only burlarj for steemit, Anoda me na counterfeit...

  • d main reason wey make me like naija pidgin na d people wey dey der, jollyment too dey yafunyafun, na everyday dem dey do contest....

  • i dey see improvement everyday, naija pidgin community dey grow, make una kontinue dey host contest and c wetin go happen within d next two month, no tank me now for the advice, make una tank me later and na @zizymena carry me come the community

  • the tin wey dey pain me be say since I Don dey for dz community, I Neva chop their card before, I Neva chop their sbd, I neVA win something at Al and e dey pepper me for body, there is God oooooo..

FB_IMG_15219825788762115

All d best

Thanks dear

You do well. We don accept your entry

@burlarj you too like contest o

Lol, if I no do contest, who else go do am

me go du ham nah

Feel free to join Padi

Fine man, no be lie

Smiles, my oga

Na so my broda, Naija pidgin ppl get enof jollyfication😋

hehe, No be lie

Na you get am Nigga, you fine like fish..... 😂😂😂

Lol, abi na, I no dey carry last

@burlaj wey no dey dull. But as u pose for right you for show them babes ur six packs oh. Abeg win jare

Laugh wan kill me, I will show una next time

Burlarji-lee. My kokolet man

Dhavey-lee. My personal person

You dey gallant bro!

Thanks baba

Enjoy brodaly.... i dey wish u success

My oga tanx

bring home the medal, bro

Pop pop my real g

I pray you kukuma win nice one boss

I Don win already

BEst of luck

BEst of luck

Fine dude, nice one

chair.
Laff no gree me laff.

Goodluck oo

As u see me so my name na omokaro Fredrick aka @fredoski for stemit .

  1. As e be so we only get one easy way of communicating in naija wich na pidgin language so as e come be so for stemit naijapidgin community I too believe say na the best way for stemit Nigeria becos if u check u go see say other countries dy use their own language for blogging dats y naijapidgin go remain d best for naija
  2. D tin be say dis community need to spread around the world say to say make our stemit brothers may dey abroad to know say naija nor d carry last and may dy also communicate wit d community as well. My oda opinion be say each an every member gat to promote n support d community as well becos e nor easy to blog at all.
    na for one group chat name @bund I for see d correct community @naijapidgin
  3. As for me I like anytin may dey sup for dis community wetin me I believe for na the growth of d community . So up live @naijapidgin
    4.#baseonlogistic I be Edo pikin for South south
    Always on shaku level
    FB_IMG_1520507674884.jpg

Your entry dey valid. We dey wish you well

I love the entry i wish you goodluck

You try with the comment.

Tanx dear we rep naija

I believe your spirit broda...no level for devil..you go win nae base on d shaku level.

Make sense, see hw u soft.
Shaku shaku😎

Yes oo shaku level

Carry go

We dy togeda in spirit

Correct!!! Ur entry mk brain finish

Tanx na God give me brain

Southside to the world

Edo nuh dey carry last

Omoba na I be son of the soil

Baba you tight for your way. No lele.. Carry go.

I respect u bro notin do u

Greetings broda from the waffside..base on logistics u r carried

TNWarri I too believe whona #baseonlogistic who I be

Stevenson7 don show, oooh make una clear road, oya clear road for the boss 😁😁.
Abeg ooh na joke ooh, abi confam minnow 😁.

  1. Chaiii, he no get plenty thing wey day sweet me for belle, but this one day among. The naijapidgin community na way of promoting we own language, the one wey we like to day speak well, wetin make me like the naija pidgin be say na the first of hin kind and na one language wey I day like speak, naim con still enter Steemit so, I no fit happy, all the Opie pie pie pie [english] grammar wey me day yarn for here don taya me walai 😁😁😁.
    2.as the community day so, everything day campe, me been still day reason say the community fit day do promotion of best pidgin post abi that kind thing 😏.
    Na for mama @ogoowinner forum naim I for hear this beta ooooh
  2. As he day be so eehn, everything day well ooh, everywhere good as he day be so, but I for still like make he no only be for naija ooh, be like Ghana and some kind African country day speak pidgin that year na 😀.
    4.IMG_-z6ai2z.jpg

Anyways my name as he day for my blog na Onyejekwe Chukwuebuka Steven but for Steemit na Stevenson, na me just carry the name as autocorrect for my handset suggest am for me so😁, na Anambra pikin I be.

I dey feel you ooo

Thanks boss, I day hail🙌

See as him keep face like monkey

You love the face like that na abi you no go talk true😁

Stevo you na correct guy nah

Boss ikechi, I day hail ooh 🙌🙌

I hail too. To write pidgin hard pass to speak am o

My guy, no make me bite tongue as I dey try speak this pidgin o.

You set wells sha
But your face con do one kind sha

You smoke 😂
Na me and you day ooh

Suny bro, this your pose no be here ooo

😂😂😂😂😂, you love abi 😂😂

E set sha o.. I bin tell you say na ur face be this you con dey deny am.
Now wer you Don see 10sbd you Don carry am put..
carry go sha.
#ugly boy

😂😂😂😂😂, he fine pass your own

Smh .. so yhu dey use fake name

Sharap phoool🙂😂😂😂😂😂

This na my correct guy. Nothing do you

Boss prince thanks alot 🙂🙂

Da bros u tight for diz corner, see as de tin Jx de flow for ur mouth lyk tap.. Collect one kposa.. I dab for u

Congratulations in advance

This one na just dodo

This one na just dodo

I wish you all the best @stevenson

Very funny

  1. The originality of pidgin cos na em be senior broda of other yankee language.

  2. As the country mata don scara so, say monkey and snake colonise our money and shuck inside knicker. We need to dey yarn dis kind mata make we use laugh take reduce the tension our government of dAPChi dey give us. Na who get for face fit dey greet him neighbour good morning.
    Na for @jeaniepearl interview wey @ogoowinner show face as guest na i take know of naijapidgin.

  3. This one no pure for me as i just land with my ebuka agbada inside my naijapidgin private jet. Make i leave this one for people wey don pay ground money or the elders of naijapidgin village square make dey yarn their mind

  4. IMG_20180302_153250.jpg

Your suggestions tap bros. Carry go. No lele.

Your entry dey valid. We dey wish you well

Your yan no be here ooh brodaly, you dey valid 100%. I know no wen our country turn animal kingdom.

Carry go naijapikin on behalf of warri people's we say no carry last

Omo babe, u tap dye. Kpatakpata na draw

More Grace my guy, e sure for you

I for just tell you now now so, sey u don win already🤓. Nah just sey no bi my levels ya. All join, carry go my broda

Hahaha, i no wan get shoulder part yet till the race finish

U for kukuma smile small now. Goodluck bro

For dis kind country, smile take holiday

Na so, no shaking abro. Carry go

Tnk broda

Una babe don show o na my name be @rosyblessing

  • @naijapidgin too make sense,na the wey dem dey yarn and the originality na im make me like the community. All of us dey play and we dey free to talk our mind.
  • Make we tell other people for steemit make dem know about naijapidgin so that the community go grow. Na @Zizymena yarn me about naijapidgin
  • For now o as I dey new for the community I Neva notice anything wey bad I dey gbadun una.

IMG_20180325_155906_082.JPG
Na my entry for the contest be dis oo

Na You fine pass

Beautiful

Best of luck

Na my correct person be this... Abeg win make we share the sbd. 😂

Your pic na sekem sekem

O boi. Even tho una picture dey down na hin my eye see first. Dis one na banger o. Go carry the prize come house oooo

Babe, nothing do you, na you get am

Fine bae
You look like zizy, una family?

Na my sis from another mother

Bae Na you get am, if you no win I go burn my iPad.... But thank God say I no get Sha.... 🙌 Finest, you don burst my brain finish

Aswear die, I gbadun them wella. Carry go bebe

You too fine oo babe

sweetest babe ever

I like this lady so much...

see fine girl

Cute nah understatement for how this picture take fine.

Keep it up babes

You make sense die. I dey feel as you dey shine

This one na ogbonge. You look good by the way

Carry go my dear, naija pidgin steemit community happy say you dey rep us wella

See as you set finish come be like my favorite coconut jollof rice.
Gbamest!!

Omo, you set die , as i don see your pics i cant think straight again ,chai !

Oya make una tuaily for the baba. Bob don show. I don land gidigba for naijapidgin crib. This one na original sukusu

As I dey so, na for baba God kabã I chill dey throway salute.

Make we do the koko

  • Una go gree me say" I gbadun we language like oyinbo gbadun to dey tãfé (cigarette). As Monkey nor dey carry eye see banana.Naijapidgin na we mama tongue tale tale, and I fit yarn am as I sabi.
    E no be like oyinbo own wey we must to yarn like how e take be.

  • Na shekele thing una get to do wey go make we community better. Make una find agbara for we steemit (SP) to take helep we country people for this area.
    We country people for here no dey see water drink well. I day my own jejely wey person carry put for wasap. I be wan waka comot, but tori been change as I see say na tiwantiwa.

  • Shey una sabi say person wey do yangayanga for this we steemit, we go give am gbege. Una never do me strong thing so I full ground for here. Some pipu dey samankwe but una be correct man pikin.

Your entry dey valid. We dey wish you well

I de see u sir.....

Thank you correct persin!

OK I don show, make I no carry last, 😂
Wetin make me like naijapidgin community nesay, Omoor the group make sense diee, as in na every day dem de share goody goodies for the group and na who no like better thing? 🤣 then, the grp de very lively, noise makers full d grp Naim make I too gbadu d grp.
Me I no see anything wey Una de do wrong o, if anything go change for that group make e be say na every minute dem go de share goody goodies now 😂 lol.

Na my sweet friend @diamondrich aka Jesus luv 😂 Naim bring me enter the group and I thank her..

Now my pisure 💃 IMG_20180325_074345.jpg

Greetings my pipo @diamomdrich all the way from warri city! You say👂? Ok make i drop my own sharp sharp now as e dey hot make e no burn my hand.

  • I like naijapidgin community no tor small, this people dey bring us fresh news as e dey hot everyday so tey i no come dey bother listen to news for fm again. Creative minded people nai full there, no dull moment, people dey even dey sleep there sef 😁.
    Naijapidgin dey trowey contest everyday for people to win prizes such as upvote, recharge cards and sbds. Almost everyday nai mi dey win sbd (hope say my village pipo no hear this one make dey no pour sand sand for my garri 😁)

  • To me, naijapidgin don better already. Notin to add again, e better pass 98% of other groups wen i don come across for steemit, sotey i abandon my other groups for this one. I remove cap⛑
    for una.

  • As e dey hot, na @zizymena nai nack me about this ogbonge community, make e for no loss nai i join o, i no fit shout 😁.

  • You say👂
    If i say una do watin i no like nai bi say i no like better tin for this my life..... Naijapidin, nothing do una, make una carry go!

IMG_20180324_102036.jpg

My humble self @diamondrich

Fine babe
U pure

She still tight 😁

Classic babe😁

😍... See beauty ooo

You too fine

Your swag for the pidgin carry weight joor, no dulling carry go

You dey represent waff town wella.. Na you dey run

Mummys ko...i hail oo..nice one

Fine girl..beta pikin

  1. Wetin make me like naijapidgin be say na free place to yarn your mind and you fit see plenty people wey you fit play with. Naijapidgin be like school, you dey learn and you dey play.

  2. As e be I like to dey yarn people about naijapidgin well, I don meet people wey dey Steemit and wen I yarn them about naijapidgin dem rush come. I even dash dem whatsapp link sef. To dey resteem sef, dey help am grow wella. Na for one hot post wey i see @ogoowinner wey she still dey do her contest wey we go change English to pidgin. Na there she yarn about naijapidgin, na so I carry my leg Waka see am.

  3. Wetin naijapidgin dey do we me no like, maybe na me ooo but I dey feel say some people dey form cacus for there, like na my person be dis. Another thing again na we be 102 people for the group, we no even reach 20 wey dey yarn.

4.FB_IMG_1521900795121.jpg
Na my new look be that.

@tutufaith don't be surprised seeing you here again. @tyrex from the @airhawk-exchange. Make sure you win this.

Chai... See fresh girl

See your life

Your entry dey valid. We dey wish you well

Hmmm soft fine bae

Zagadat..my people say as e dey hot, naso e dey go..so here na my entry.

1 the first time wey man pikin join this our obodo steemit community, man being just dey do am just to gather small money take hold body no fun inside at all but every every change the moment wey man pikin sabi abt naijapidgin...naijapidgin na the only place wey you go come jolificate con still win small something inside..ah ah that one na weyti we country people dey call double awoof abbi no be soo?

2 weyti me think say una go fit do to make this we community better pass like this na concerning this we contest matter...una no dey give we admin power and e no good...our ogbonge admins suppose to dey pick winners sometimes on their own..at least that one go let us sabi say dem admins get small power and e go make people respect we admin..because if respect no dey things fit go wrong oo. And na @udezee tell me about this our ogbonge community

3 as for me ehn..everything wey una dey do dey swit man belle ooo...I remember the first day wey I join naijapidgin whatsapp group..that same night na e I win card iyoo.. @zizymena na e sama me the card. My body swit me no be small.

JPEG_20180314_171426.jpg

Keep rocking baba. Nothing do you.

Kai! Bros, you finish talk for here...I just dey smile as I dey read your entry. Carry go!

Baba, you fresh paa. Mr Steem Nigeria.

On point my guy

The reason wey make me like naija pidgin be sey:
1.na our language e be.everywhere,wey you go,whether na school o,or na market,even for offices na naija pidgin dem dey speak.

2.naija pidgin dey flow well well for ear.if you dey read post wey dem use naija pidgin write,e go dey sweet you for belle well well like sey you dey there wey the thing dey happen.

3.E dey easy to understand.e no be like all those big big grammer wey pipple wey sabi English dey speak.For naija pidgin,you no nid to carry dictionary.everything dey easy.

(B).Wetin we go do to make am beta as e dey before be sey we go make many pipple sabi sey naija pidgin na de koko wey dey now.

We go still dey invite pipple make dem come join our watsapp group.and if we dey write post with naija pidgin,make we dey try dey make am sweet well well,so that people wey see am, go won join.if person write post wey sweet,make we dey upvote that post and comment too.

(C)Person wey tell me about naija pidgin,na ma friend Omovre Faith.a.k.a Zizymena for steemit.

(D)Em i no too sure e get anything wey una dey do wey i no too like.But my advice be sey make una try to dey improve d quality because i believe for small time,naija pidgin go cover everywhere.

IMG_20180324_074018.jpg

My fellow naija steemian, I dey hail una from my small corner for Warri. First of all I won thank God for the naija pidgin community beta thing wey dey happen for community. This community na ogbonge one

  • The first pidgin community wey dey inside blockchain, even Google know say pidgin don hold ground for the world
    Screenshot_2018-03-25-13-35-04.png.
    For steemit no go dere
    @naijapidgin go hold ground wella
    Which naija pesin no like beta thing. Naija pidgin community na the only one community wey I know wey dey show appreciation the way them dey give back to community member. People don lick mouth tire for this community for free free thing sha and the post for the @naijapidgin blog na true life story mata dey alway dey drop wetin dey happen for area as we see am

  • Well naija pidgin una dey try oh na small sha as our people talk say na from clap d dey enter dance. For me make una give some people chance to be contributor dem una give small percentage sbd wey the post go generate. Make una still add crack ya rib day* for correct pidgin joke.

Na tru @diamondrich I take land here

  • As I say before una dey try make una continue. Na make the community spread like bama on top of agege bread 🍞 naim be the matta and this one go fit happen if @naijapidgin dey do some small upvote beta post for community member becos people here upvote na race dem go take join the community as we know say if you won gada ants put sugar for ground dem all go show from all corner.

Is na me be dis na inside church I snap this picshure. Shebi I resemble my papa?
IMG_20180325_141806.jpg

You try. Your entry make sense.

I hail @ogoowinner, you just totori me with d way you answer me

  • Apart from say @naijapidgin dey use our language gongon take yarn with us for this platform, nna we own tin and we must to support am. No be dat alone sha... Card, contest and plenty tins wey una dey do abeg una too mush jare!!

  • for my own side na @ogoowinner I fes see as she resteem una post naso I say ah!! dis kain page idey, everywhere for here nasoso yamayama language d dey talk so for d fes time I see my own I rush join. Nothing wey una go do for now, d tin be say una dey d correct path fesfes. Muna just continue that way and maybe later una start dey support others' project and finally get voted for as a witness.

  • Sofar say na we own tin, person no go fast see fault but Wetn I for suggest be say upon the 3groups wey we get i.e watsap telegram n discord make we choose one for admin or serious info concerning us or naijapidgin n I suggest mk d group be d watsap OWn bcos everyday d group d get like 1500+ messages and I no d fit read am finish. So if we just say okay general chat room na for discord, admin go get watsap group for serious info, and maybe d telegram group to dey teach newbie on how d go d take do thier tin for steemit... Na my own b that.

  • PicsArt_12-30-07.06.27.jpg

my pipo mk una see me here o. I troway salute give all the ogbonge friends and admin wey dey here. God bless una, happy Sunday.

Your entry dey valid, we dey wish you well

The @naijapidgin community

  1. The community na the first indigenous one wey dey steem. Beta tori and informat dey always dey on top this blog. The community dey full of elder with wisdom from different works of life. There is never a dull moment as i don dey with the community. Different chat wey dey make mind happy and for soul merriment just dey show for @naijapidgin whatsapp and telegram channel.
  2. I sabi this group through @ogoowinner blog. There is no perfection in life therefore beta things still dey wey dis group fit do. A curation-trail for the group go dey alright for its member. Also promotion of member post by resteeming go help its members beta for steem.
  3. Hmm, this one dey difficult to yan. As i no see anything bad for @naijapigdin as of today. My only problem be say, make them facilitate with new steemians that may dey confuse for the platform. Weekly orientation on one or two does and don't of steem community will help its members.

IMG_20180322_190954.jpg

Your entry dey valid. We dey wish you well

My people for @naijapidgin i greet all of una o , me your boy @blackempror don miss una contest gan far , as i dey check your blog na him i see this correct contest wey i decide chook head for , one thing wey una wan start wey i no like as per me na this highest upvoted comment , abeg person like me wey no get people wey go vote for me now no get hope sey i go win.....abeg make una concider us , abeg where @ogoowinner dey? , I don miss her o , as per wetin i like for @naijapidgin na @ogowinner me like o and una contest and how u dey help our country people.......GOD bless Nigeria God bless @naijapidgin....IMG-20180322-WA0026.jpg

Nothing good dey easy to get for life so go hustle my broda

i greet everybody wey dae here, how una dae na una boy ooh samsonike, na my own entry for this contest be this.

  1. Wetin me take like naijapidgin be say na free place to yarn wetin dae pesin mind and you fit see plenty people wey you fit follow talk and play with. Naijapidgin na like one community wey be say people for that community like each other an dae come be like brothers and sister,and this community self dae bring us together.
  1. i sabi naijapidgin through our mama at d top @ogoowinner who tell me about the group and i remember say i drop one pidgin post for that valentine period and they help me wella. and na since then i don dae enter naijapidgin blog.

  2. i never see anything wey naijapidgin do wey bad sha but Wetin naijapidgin do me one time like that be say i drop one pidgin post and they now upvote am, and i wan make all of us for here see each other as brother and sister ooh, make we no fight.

i remain una humble boy @samsonike

12038518_904801579601378_8638388298775810937_n.jpg

  1. Wetin I really trip for about this we community na d originality of d language we dey use relate o. All of una go just agree wimme say e dey easy to yan person mind with this pidgin language unto say na like our mothertongue. Person no need teacher to learn the language at all.
    Another thing na the kind happy people weh dey d community, with dem, dulling na impossibility.
  2. Wetin I go suggest make una dey do na to dey make Friday special as una dey make Sunday special, make e no b like say religious sentiment dey d community.
    Na ontop genesisproject community I hear about d birth of naijapidgin community from @ogoowinner specifically.
  3. Na unto religious preference o, make una stop to make Sunday important, come leave Friday behind. As e b say Islam and Christianity na d two major religions 4 we country, Una suppose recognize the two. If Una fit dey do contests based on Sunday church movement, make una dey do on Fridays too based on Jumaat service.
    I no kuku be muslim, na just my own observation.
    All of una weh dey make us jolificate ontop dis we community unto different contests una dey arrange dey use bless we, I dey ontop postrate dey hail una o, God go bless una yapayastically.

Steemit, I hail o...
@naijapidgin, I hail pass...
IMAG0491 - Copy - Copy.jpg

  1. The reason why I like naijapidgin na bin say e dey different from other blogs. Some people bin say pidgin language no be correct English say den no fit speak am but for here you fit express yourself anyhow.
    And person no fit form with pidgin
  2. the thing wey be say I think say naijapidgin fit do be say make then try create enough awareness cause no be all we Naija people know this blog
    Na @desmonddesk yarn me about this blog
  3. i no see anything wey bad wey una dey do oooo
  4. IMG_20180114_042818.jpg
    Happy palm Sunday

Your entry dey valid. We dey wish you well

Babe you fine sha. Dat white fit you well well.

Oya i carry hand give oga for naijapidgin and everybody wey be members o. I greet una say happy palm sunday,hope say una service sweet for your side?

Anyway make i go straight to the koko

  1. I just dey stroll dey read people post na im i come branch see naijapidgin. Them talk say na pidgin we go dey use yarn for there,na im make me happy say make i join since i don see my people. Infact,na pidgin you fit use express unaself very well wey people go understand you. I gbadun the people wey dey whatsapp group too much,dem be like family there.

  2. Like wetin i talk say i dey stroll see una post,nobody carry me come o,na carry i carry myself come meet you people. As per wetin we go do make this community better na make you guys create awareness much so that people wey dey stroll like me go see una post come join too.

  3. I no fit talk wetin bad thing una dey do wey i no like because i just join una and i no wan dey jump matter come dey judge una,but as time dey go,if i see una character,me go yarn una o. I no dey hide at all

IMG_20180319_075359.jpg

This is real me,hope my smile is sexy?

Upvoted very nice post bro

My country people wetin dey puyeke na. Based on logistics me na dat guy wey dem sabi as area pastor wey dey deliver flows to area members, dem guys and omotogbe as e dey hot. Me na una home boy @Oshiokhenhoya may una dey shew my name for mouth as e dey hot. May una no go dull am for area may dem no dagbogbana una oooo.

  • Wetin make I like for Naijapidgin na say e dey sweet person say in follow person tok for language wey dem gather dey tear. Pidgin wey we dey yarn sweet pass English for my syd oo. Na y as I bin enta Naijapidgin I see say dem dey yarn like say na one mama n papa dem get. D thing come sweet me sote I dey tell my own say may dem enta dis posha levelz for Naija pidgin.

Another thing na say una dey write as e dey apen for area well well. As e b so una dey give people wey no sabi as e dey go street OT may dem no dull for area .

  • Me believe say may Naijapidgin dey organize contest wey person wey dey do am go resteem am. D reason na say me go lyk am may dem world n oyibo sabi say we get language wey we borrow still come make am sweet lyk honey koso. Abi may I ask una if pidgin no sweet to yarn for mouth pass English? As I dey English dey draw for my mouth like okro.

Na my area sister yarn me about dis community na in I come follow @zizymena say may she send me link wey I fit take join.

  • As e b say e neva too tey wey man pikin join dis community man no fit tok, but I fit find something tok oooo if una go drop SBD as e dey hot.
  • na my picture wey gboyan wey ugly as man pikin no fyn na. My face b lyk wetin dem take seperate fight, if una fit remember say na me seperate jesus and judas wen jesus wan beat am as in betray am. Na joke I dey oo n na my picture b dis. I hail ooo

IMG_20180221_133520.jpg

Dis one make sense wella

Respect
U dey alryt

my country people I salute una.

  1. wetin make me like @naijapidgin so, na say we bin dey family level with pidgin. we dey take everyperson as our broda and sisto so.

  2. wetin me think be say make una dey organize context wella, make una dey upvote we posts.

Na for one whatsapp group I see naijapidgin o na so I nack the link com see say naijapidgin join.

  1. I just join this community so, I never see any yakata point sha.

  2. IMG_20180318_100400.jpg

    na my own entry for we post be this.

I hail bro
See as u fresh like hot akara 4 joint

You sha wan whine me. Kwantinu

Wetin dey work u

U dey erect bro

my name na @dollypee i still dae new for here but i wan drop my entry.

  1. me just like naijapidgin community no be small, d group just dey bring us fresh news as e dey hot everyday, and dem dey give us chance make we take pidgin dae talk and discuss matters arising. Naijapidgin dey trowey contest everyday for people to win prizes like upvotes and sbds. Almost everyday nai people dey win sbd.

  2. as me take see am oooh, naijapidgin don better already. Notin to add again, he good dotey me like to dae dey here than all othergroup. for this one. I cut cap for una.

  3. me ooh never see anything wey bad wey naoijapidgin dey do sha, u no say me never too tey for here, me just want make them dey do wetin dem dae do dey go.

na me dey here dey talk since oooooh @dollypee make una no forget to follow me, resteem my post,come upvote me join thanks.

IMG_20180209_122014.jpg

The background use style resemble delsu

Abeg clear road gimme jare. See as beta tin wan take pass me but bros j no go gree.
My name for this steemit na @marvettsy but the name wey my papa and mama dem give me na Marvelene.

I wan follow drop my comment oh.

1.Wetin do make i like @naijapidgin be say, as we dey dis naija eh,no be all man fit speak this oyibo language dem and na pidgin dem go use feel at home. Abegi na naija we from,why I go come dey strand for my papaland?

2 Wetin i think about @naijapidgin be say , make una try publicize this una movement because me sef,na from person blog I see una contest come comment. The guy name na @burlarj and em no know sef😉. Una contests and upvotes go helep all man.

3 Una dey try abeg,I no hate anything about una oh,make una continue the good things wey una dey do.

4 Oya time don reach,mah put my pichur. No be like say i too fine sha,but manage abeg
FB_IMG_1522095224676.jpg

Mah join una whatsapp group sharpenly.

Me na typical Akwaibom girl..

Goodluck dear

who is this fine girl En?

@dhavey,it's me na

You know me?? If yes hi me on whatsaap. Thanks

Na my cousin sister frnd wey dey related to my grand parent uncle senior brother. Vote, u dey ask question

Yowa! C cute smile, you fine wella baby

Mehn..! I don show, On a 4g level na the Koko be this, even for Steemit make we dey yarn dey go for pidgin , d oyinbo wey I don dey yarn since don Taya me sef, Naija no dey carry last, make for promote our ongbonge languaja for here @naijapidgin carry dey go we dey your back, no Kai no lele.

1 naija forever.

I dey fill una, na salute I just dey salute o.

Upvoted bro

Dear friend, you do not appear to be following @wafrica. Follow @wafrica to get a valuable upvote on your quality post!

Please

Not this is spam

Hehehehe! Leave them o! Dem fit upvote our account for us. Lol!

As your lordship pleases

I no come do contest. I just dey look fine fine picshure wey my people dey drop for the comment. I no Now sey steemit people fine like this sha. Anyways, I wish una wey dey do this competition success....

if u b upvote me regular i wiil do same @jonizwillium02

E do me jigi jigi gbamgbam to see dis kind passion wey our mama put for her country pipu and E com pain me say I no fit join dis contest as fa anytin wey join plenty comment and upvote no dey work well for my system.

Here na my contribution though I no put am eye for contest.

  1. Me I like naijapidgin for many many tins, one be say e dey promote our culture and value as naija pipu and dey give us avenue to talk mata freely without fear for error wey involve beta English .

  2. Nobody yarn me about the group I just carry pipu link find my body here. And I see say if we dey get talk wey fit b ones in a week about how not to leave our culture , how Oda pipu culture dey operate so we go dey understand the pipu we dey meet and sometimes just throw contest to see how we take know our country.

  3. I never too tey to take know wetin wuna do right or wrong, but from wetin I dey see from our mama ogoo, she dey try, we no fit please everybody or reach everybody as fa pipu plenty here